Buhari United Kingdom travel: Nigeria president postpone London medical trip

Buhari

Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo

President Muhammadu Buhari trip wey im plan go do for UK don dey postponed.

Di statement wey reveal dis come from Buhari tok-tok pesin on di day wey di Nigerian president suppose enter plane go London.

"Di medical follow-up visit of President Muhammadu Buhari to di United Kingdom wey dey scheduled for today, Friday, June 25, 2021, don dey postponed," Femi Adesina write.

Adesina no reveal new date for di trip, but e say dem go announce am "soon".

Dis no go be di first time dis year wey Buhari don plan trip to go foreign kontri go do medical check-up.

Di reason why dem cancel Buhari trip to UK no dey clear yet, but e dey come on di same day wey some pipo for UK dey do peaceful rally against wetin dem say na di bad treatment and kill-kill of Igbos for Nigeria.

Buhari dey comot from presidential plane

Wia dis foto come from, AFP

Buhari many 'foreign' treatments and check-ups

Di 78-year-old president don travel abroad many times for medical reasons throughout im presidency, but im administration never for once reveal wetin Buhari illness be.

Dis don make Buhari chop accuse say im dey travel for treatment wen im own kontri public health system dey weak.

2016 Buhari UK trip

Eight months afta Muhammadu Buhari become President of Nigeria - on February 5, 2016, e travel go UK for im first holiday and return on February 10, 2016.

From 13th to 15th May, 2016, Buhari attend di first ever Anti-corruption summit inside di United Kingdom wey many heads of state from around Africa also show face.

6th to 19th July, 2016 Buhari go London on Sick leave.

"Muhammadu Buhari London travels for United Kingdom medicine"

Wia dis foto come from, FACEBOOK/BUHARI SALLAU

2017 Buhari UK trip

7th May to 13th August 20, 2017 Buhari go London on sick leave {na during dis trip dem say rodents alias rats take over di president office inside Aso Rock wen im come back]

21 to 25th September, 2017 di 78 year old Nigerian leader take anoda trip to London on holiday.

"Muhammadu Buhari London travels for United Kingdom medicine"

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad

2018 Buhari UK trip

9th to 19th April, 2018 Muhammadu Buhari enta London for meeting of Commonwealth Nations.

8th to 18th May, 2018, di Nigerian President visit London to see doctors.

3rd to 13th August, 2018 Buhari go London for holiday.

"Muhammadu Buhari London travels for United Kingdom medicine"

2019 Buhari UK trip

25th April to 5th May, 2019 President Buhari do private trip to London

Presido Muhammadu Buhari travel go United Kingdom for 'private visit' from 2nd till 17th November 2019.

2020 Buhari UK trip

Di Nigerian president depart Abuja go London to participate for di first UK-Africa Investment Summit wey happun on 20 January, 2020.

2021 Buhari UK trip

President Muhammadu Buhari of Nigeria take off to London for medical check up on 30th March, 2021 for two weeks.

No public record in Nigeria don show who dey pay for all dis private visits of President Muhammadu Buhari.

Buhari UK trip funding fit dey come from Nigerian tax payers, but dat na informate BBC Pidgin never fit verify.

"Muhammadu Buhari London travels for United Kingdom medicine"

Wia dis foto come from, Bashir Ahmed/Twitter

Di exact sickness or health challenge wey di 78 year old president from Katsina state, north west of di kontri dey always travel to UK to treat, no dey known publicly.

Both di goment of Nigeria, di president office and Buhari family keep di mata private.

United Kingdom, wey di three time Nigerian leader dey travel go for treatment, still dey on lockdown sake of coronavirus pandemic.