Nnamdi Kanu latest: Mike Ozekhome lead lawyers for di Ipob leader trial as court adjourn case to Wednesday

Nnamdi Kanu
Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu and new head of his defence team, SAN Mike Ezekome

Nnamdi Kanu no plead 'guilty' or 'not guilty' to di amended charges wey dem sama am today as court adjourn di trial to Wednesday, 19, January, 2022.

Di defence for di Ipob leader tell di judge say im no fit plead sake of say di defence team neva get time to study di amended charges and follow dia client tok.

As e bi, di court don adjourn di trial to di 19th of January, for di defence to study di amended charges and tok to dia client.

Na ogbonge lawyer, Senior Advocate of Nigeria, (SAN) Mike Ozekhome na im lead di legal team on Tuesday wen di leader of di Indigenous People of Biafra,(Ipob) trial continue.

Earlier on, Nigerian goment file fresh additional charges against di Indigenous People of Biafra (IPOB) leader, Nnamdi Kanu, from seven to 15 as im trial resume on Tuesday, 18, January, 2022 for court.

Kanu bin dey face seven count charge wey border on terrorism, treason, secession and dat im be member of IPOB group wey goment don outlaw.

E also dey face accuse say im dey broadcast lie about President Muhammadu Buhari but Kanu bin don deny all di allegation.

Nnamdi Kanu and Mike Ozekhome
Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu and Mike Ozekhome

Kanu legal team wey confam di new charges say goment file di charges barely 24 hours to di main trial.

Ozekhome bin tell BBC Pidgin say DSS neva allow am to see im client.

E say, "dem suppose give us di amended charges as time bin dey make dem amend am give us and di defendant, Mazi Nnamdi Kanu but we no see am till yesterday". E conclude say e tink say dia plan na so di case hearing no go hold.

Oda tins wey happun for Kanu trial

Ozekhome also hala on top some issues about di fundamental rights of Kanu say dem no even allow am as di lawyer to show am di charge sheet.

E also tok say Kanu no dey chop well, dem bug im room and say e neva fit change im cloth since im detention.

Justice Binta Nyako wey be di presiding judge come give order to DSS say make dem try change Kanu cloth before e appear for court on Wednesday.

E also ask di DSS official to allow di lawyers dem to talk wit Kanu for inside court about di charges before sem cari am go back custody

See more fotos from court.

Nnamdi Kanu
Nnamdi Kanu and im lawyers
Kanu legal team
Wetin we call dis foto, Nnamdi Kanu legal
Nnamdi Kanu
Prosecution lawyer
Wetin we call dis foto, Goment lawyers wey dey prosecute di case